cast

Naija

Etymology

From: English cast

Pronunciation

kâst

Play Play

Verb

  1. Make person talk di ting wey anoder person do or wetin anoder person or someting be.
    • If you no stop dis kurukere waka, I go cast you.  — (If you don't stop all these crooked acts, I'll expose you.)
    • Na so e go pass imsef, na im e ojukokoro cast am.  —  (He tried to bite more than he could chew, then his greed exposed him.)
  2. Make person or someting wey bin good or wey people dey respect no con get level for people eye.
    • Omo, you don cast for street.  — (Sir, you have been exposed.)
    • I no know who go talk yeye talk o, but di matter don cast.  —  (I don't know who spoke stupidly, the matter has been exposed.)
    • Dat club don cast naw. Any small team fit beat dem.  — (That football club has lost its respect. Any small team can defeat them.)
  3. Make everybody con sabi someting wey be secret before.
    • • Di way wey di matter cast eh, im no believe am. Im bin don dey tief money since, con dey give di gateman small. Im oga don sack deir two.  —  (He could not believe the manner which the issue became public knowledge. He had been stealing money for a while and he was also giving some to the gateman. His boss has sacked both of them.))

Related forms

casting

Translation

English exposed