fall

Naija

Etymology

From English: fall

Pronunciation

  • fɔ̂

Play Play

Verb

Intransitive

  1. Make someting wey standup before reach ground.
    • As e be sey you want dey press phone dey waka, you go fall naw.  — (NSC_2021, Since you keep using your phone while you walk, you'll fall of course.)
    • Stand up abeg, na small gutter na im you dey fall put.  — (NSC_2021, Stand up please! You fell into that small ditch.)
  2. Make someting go down.
    That big house wey dey Ibeju Lekki, fall yesterday o.  — Egbokhare_2020, That big house at Ibeju Lekki collapsed yesterday.)
    E fall.  — (IBA_13_Road-Safety_M__39, He/ she fell.)
  3. Make someting drop for ground.
    Heavy rain come start to fall.  — (jw__17548, Then it started raining heavily.)
    Rain come dey fall.  — (ABJ_INF_04_First-Time-In-Abuja_M__16, Then, rain started falling.)
  4. Make person start to dey like person
    • Na mumu dey fall for person.  — (NSC_2021, Only fools fall in love.)
    Na small small talk and all dose yeye midnight call dey make you fall for am so.  — (NSC_2021, All those small talks and stupid midnight calls have made you grow feelings for him/her.)
Related forms
Synonyms
Antonyms
Translations
  • English: collapse, fall, develop emotions

Transitive

  1. Make someting disappoint person.
    • If I go dat one, di thing go come fall my hand.  — (NST_cleaned__201, If I attend, I will be disappointed.)
    • Wetin you with am don first talk, you later go fall in hand.  — (NSC_2021, The both of you had agreed and still you disappointed him/her.)
  2. Make dem kpai person
    • De fall person for main gate.  — (NSC_2021, Someone has been murdered at the main gate.)
    • Wetin do am? Person fall am or e sick die?  — (NSC_2021, What happened to him? Was he murdered or did he die from sickness?)
Related Forms

fall hand, fallinghand

Synonyms

kpai, kill, off

Translation
  • English: disappoint, murder, assassinate