ground
Naija
Etymology
From: English ground
Pronunciation
- grănd
Noun
- Na part of dis world wey dem dey waka ontop.
- E come fall for ground. — (jw__5558. It fell on the surface of the earth.)
- As de boy just dey ground dey shake because of de epilepsy, di oder children begin fear, nobody gree near am. — (NSC_Legbeti_2021. As the boy fell down and began shaking badly from epilepsy, the other kids got scared and didn't dare go near him.)
- Make e be sey person dey available for anyting wey want happen.
- Na we dey ground. — (LAG_38_Elections_DG__75. We are the people available for eventualities.)
- I dey o, I dey full ground. — (WAZL_06_Na-Your-Health_DG__10, I am fine, I am very fine.)
- Soldiers and police dey ground to control di protests — (bbc__90798. The Soldiers and Police are ready to prevent riot from breaking out.)
- Matter wey dey available.
- Plenti tori dey ground for how di soldier take die. — (bbc__82045. There are different accounts on the death of the soldier. )
- Confusion bin dey ground as to weda pipo die; — (bbc__26119. It was unclear whether there were casualties or not.)
- If na for di matter wey dey ground na im you wan put mouth, put mouth. — (WAZK_09_Fuel-Price-Increase_M__84, If it's the matter on ground that you wish to have input, go ahead.)
Related forms
Antonyms
Translations
- English: ground