hala

Revision as of 15:06, 14 January 2021 by Bernard (talk | contribs) (→‎Verb)

Naija

Alternative forms

Etymology

From English: holler

Pronunciation

  • hálà

Play Play

Frequency

  • Frequency in NSC treebank: 2
  • Frequency rank in NSC treebank: 1982
  • Frequency in raw corpus: 84
  • Frequency rank in raw corpus: 2314

Noun

  1. Na when person dey shout as e dey talk
    • Di thing be say, as im vex enter field to hala for di referee, im carry gun for di side of im jeans trouser.  — (bbc__38844, The thing is that he entered the field to shout at the referee with a gun hidden in his jean trouser)
    • Goment charge her wit murder - but afta pipo hala, dem stop di prosecution and she come fit focus on her pikin recovery.  — (bbc__54443, Although the government charged her with murder, people's loud protested stopped further prosecution and she was now able to focus on nursing her baby to recovery)
    • E come hala again.  — (katakata__10. He came ranting again)
    • Why everybody just dey hala for me now.  — (Why is everyone screaming at me?)
  2. Na make person dey greet who be im paddy wit voice wey loud
    • Haba Oga, all your boys dey here dey hala you greetings since.  — (NSC_Legbeti_2020. Boss, your boys send your greetings sir)
    • Ben, hala your friend now.  — (NSC_Legbeti_2020. Ben, send a shout out to your friend now)
    • I sabi hala my friends if e don tey I hear from them .  — (NSC_Legbeti_2020.I reach out to my friends if its been awhile I heard from them )

Synonyms

Translations

  • English: squabbles, greetings

Verb

  1. na make person sabi dey quarrel abi disagree
    • Any man wey marry woman wey too dey hala no go live long I swear.  — (NSC_Legbeti_2020. Any man married to a troublesome woman will hardly live long)
    • Di NLC don hala on top Baba Buhari o.  — (IBA_32_Tori-By-Samuel_MG__14, The NLC has called out President Buhari.)
    • Referee Antonio Mateu Lahoz send Man City coach Pep Guardiola to go sidon for stand like ordinary fan after im vex enta pitch, start to hala for di ref.  — (bbc__84864. Man City coach, Pep Guardiola, was sent to the stand like a spectator by Referee Antonio Mateu Lahoz for daring to enter the pitch and confront the Referee.)

Synonyms

Translations

  • English: Confrontation