junior

Naija

Etymology

From: English junior

Pronunciation

  • ʤúnìɔ̀

Play Play

Noun

  1. Person wey never reach senior level for school.
    • Na di juniors for school dey sweep our room for us when I dey boardinghouse.  — (The juniors at schools are in charge of sweeping our room when I was staying in the boardinghouse.)
    • My broder dey junior school and na im be di class captain for im school.  — (My brother is in Junior school and he is the class captain of his class.)
  2. Part of man body wey e dey use dey piss dey nack.
    • Na dis your junior you want make e dey tell you wetin you go dey do?  — (Will you let your penis tell you what to do?)
    • Shebi dem say e no good make you dey wear wetin do dey tight your junior? Dis ting wey you wear e show sey you get sense so?  — (Hasn't it been said that you shouldn't wear tight underpants? What you are currently doing, does it show that you have any sense?)

Synonym

Antonym

Translation

English: junior

Adjective

  • Person wey person pass for age or wey no reach anoder person level.
  • You be junior to am. E no get as e go vex you reach make you con blow am for face!  — (NSC_2021, You are younger than him. No matter what, there shouldn’t be a situation where you hit him on the face!))
  • You no know sey senior de dey for politics? Ehen, you no go jusy join party con dey raise shoulder sey you want contest. You wey be junior. You go kpro fess, look as dem dey do.  — (NSC_2021, Don’t you know that there is seniority in politics? Yes. You can’t just join a political party and start strutting around, insisting that you want to contest. You have to be calm first and then watch how things are done.)
  • Sey you be im junior no mean sey you no follow am talk sha. No be sey you go shout for am, but you go fit tell am sey “Bros. no vex, I follow you word. Dis ting wey you dey do so, e no go pay us laslas.”  — (NSC_2021, Because you are younger than him does not mean that you can’t talk to him. Not that you’ll speak rudely to him, but you can tell him “Sir, please don’t be offended, I’ll like to talk to you. This thing you are doing will not benefit us in the long run.)

Translation

English: junior