senior

Naija

Etymology

From: English senior

Pronunciation

  • sínjɔ̀

Play Play

Noun

  1. Person wey don pass junior level for school.
    • Dat senior for grammar school dat year na kura.  — (That senior student in our secondary school was quite notorious.)
    • All di senior sabi oppress junior collect deir food money.  — (The senior students are fond of bullying the junior students and dispossessing them of their pocket money.)
  2. Person wey be sey im get level pass for area.
    • Senior, as you don talk am na so e go be.  — (Leader, it is going to be just as you have said.)
    • Make we go senior house, at all at all, we go see food chop.  — (Let us go to the leader’s house, at the worst, we will get some food to eat.)
  3. Person wey be sey e first peron come dey learn work for workingplace.
    • Your senior dem never learn dis style finish, go sabi march machine fess.  — (The senior colleagues haven’t mastered this style yet, go and learn to use the machine first.)
    • Oga and senior don dey waka kurukere waka.  — (The boss and the most senior apprentice have been doing shady thing.)

Translation

English: senior, leader, elder, boss, senior apprentice

Adjective

  • Na sey person old pass anoder person or get position wey high pass anoder person own.
  • Na Ezeudu be senior for this quarter for Umuofia.  — (katakata__576, Ezeudu is an older person in Umuofia.)
  • Na im be di most senior pesin wey dem vote for inside our party.  — (bbc__5106, He is the highest ranking person in our party.)
  • Dis na di most senior official for Trump government wey go visit Nigeria.  — (bbc__41380, This is the highest ranking official in the Trump administration to visit Nigeria.)

Translation

English: elder, senior

Verb

  • Make person age or level pass anoder person own.
  • Na everything I use senior you.  — (LAG_22_I-Senior-You_DG__85, I am better than you in every ramification.)
  • I senior you.  — (LAG_22_I-Senior-You_DG__86, I am older than you.)
  • Dat guy senior me by far.  — (Egbokhare__2020, The guy is much more older than myself.)
  • Di woman senior me, but I senior am.  — (LAG_11_Adeniyi-Lifestory_MG__125, She is older than me, but I am superior to her.)
  • Di woman go fit warn di man one day sey I senior you o!  — (BEN_37_French-President-Marriage_DG__64, In the future, she could use the fact that is older than her husband as trump!)

Related forms

Synonyms

Antonyms

Translations

  • English: older one, superior