mind

Naija

Etymology

From: English mind

Pronunciation

  • máìnd


Noun

  1. Dat part of person body wey e take dey tink tings.
    • Me I know say na good mind I take dey follow everybody for dis my life.  — (NSC_Legbeti_2021. My thoughts towards all men are pure and good)
    • But men mind dey different.  — (KAD_03_Why-Men-Watch-Football_MG__71. But men think differently.)
    • Because of sey Nigeria school no gree take am, Vitalis put mind and body for wetin im sabi pass - sport.  — (bbc__19389. Vitalis focused on sports when he couldn't gain admission into Nigerian schools.)
  2. As people dey do tings togeder
    • Help us to fit get one mind.  — (jw__13797, __no translation__)
    • Nothing sweet pass one mind,  — (jw__27456, __no translation__)
    • To serve God with im heart and mind,  — (jw__37767, __no translation__)
  3. Wetin person dey tink about someting or person.
    Dem tell BBC Pidgin dia mind.  — (bbc__23694. They gave BBC Pidgin their Opinion.)
    • We fit get love and better mind like Jonathan?  — (jw__16704, __no translation__)
  4. Na say person get courage and fit do strong ting
    • He kill big snake, him really get mind I beg.  — (NSC_Legbeti_2021. He actually is bold to have killed a snake.)
    • No be sey di matter hard like that, but na if your mind carry am na im be di ting so.  — (NSC_2021, It is not that the matter is hard as such, but the issue is whether you'll be courageous or not.)

Related forms

Synonyms

Translations

  • English: opinion, courage, mind,

Verb

  1. Make person dey reason someting.
    • Me I fit fight anybody wey insult my mama. I no mind who im be.  — (NSC_Legbeti_2021. I will fight whoever insults my mother regardless of who the person is.)
    • No mind am.  — (ENU_16_Fishfarm_DG__173, Don't mind him.)
    • My papa no mind am, e continue to dey give magazine to people wey gather.  — (jw__27802. My father ignored him and continued sharing the magazine to everyone gathered.)
  2. Make person face matter
    • abeg leave my daughter make you 'mind your own business.  — (NSC_Legbeti_2021, Please mind your business nd leave my daughter alone.)
    • No mind anybodi, me and dis man here [Wilder] na di two best heavyweights for di planet, im tok.  — (bbc__5411, __no translation__)

Synonyms

Translations

  • English: disregard or ignore