mind
Naija
Etymology
From: English mind
Pronunciation
- máìnd
Noun
- Sey dat part of person body wey e take dey tink tings.
- Me I know say na good mind I take dey follow everybody for dis my life. — (NSC_Legbeti_2021. My thoughts towards all men are pure and good)
- But men mind dey different. — (KAD_03_Why-Men-Watch-Football_MG__71. But men think differently.)
- Because of sey Nigeria school no gree take am, Vitalis put mind and body for wetin im sabi pass - sport. — (bbc__19389. Vitalis focused on sports when he couldn't gain admission into Nigerian schools.)
- Sey people dey do tings togeder
- Na God we dey beg make e help us fit get one mind for dis family. — (NSC_2021, it is our prayer dat God helps us live in unity in this family.)
- Nothing sweet pass one mind for dis life, — (jw__27456, In this life, unity of purpose is the best.)
- Sey wetin person tink about someting or person.
- Dem tell BBC Pidgin dia mind. — (bbc__23694. They gave BBC Pidgin their Opinion.)
- We fit talk our mind now before di money come? — (NSC_2021, can we say our opinion before the money is paid?)
- Dem tell BBC Pidgin dia mind. — (bbc__23694. They gave BBC Pidgin their Opinion.)
- Sey make person get courage and fit do strong ting
- He kill big snake, him really get mind I beg. — (NSC_2021. He actually is bold to have killed a snake.)
- No be sey di matter hard like that, but na if your mind carry am na im be di ting so. — (NSC_2021, It is not that the matter is tough, but the issue is that the courage needed is in doubt.)
Related forms
Synonyms
Translations
- English: opinion, courage, mind,
Verb
- Make person dey reason someting.
- Me I fit fight anybody wey insult my mama. I no mind who im be. — (NSC_Legbeti_2021. I will fight whoever insults my mother regardless of who the person is.)
- No mind am. — (ENU_16_Fishfarm_DG__173, Don't mind him.)
- My papa no mind am, e continue to dey give magazine to people wey gather. — (jw__27802. My father ignored him and continued sharing the magazine to everyone gathered.)
- Make person face matter wey concern am.
- abeg leave my daughter make you 'mind your own business. — (NSC_Legbeti_2021, Please mind your business nd leave my daughter alone.)
- No mind anybodi, me and dis man here [Wilder] na di two best heavyweights for di planet, im tok. — (bbc__5411, __no translation__)
Synonyms
Translations
- English: disregard or ignore