mind
Naija
Etymology
From: English mind
Pronunciation
- máìnd
Noun
- Wetin person take dey reason and tink tings.
- Me I know say na good mind I take dey follow everybody for dis my life. — (NSC_2021, My thoughts towards all men are pure and good)
- But men mind dey different. — (KAD_03_Why-Men-Watch-Football_MG__71, But men think differently.)
- Because of sey Nigeria school no gree take am, Vitalis put mind and body for wetin im sabi pass - sport. — (bbc__19389, Vitalis focused on sports when he couldn't gain admission into Nigerian schools.)
- Sey people dey do tings togeder.
- Na God we dey beg make e help us fit get one mind for dis family. — (NSC_2021, It is our prayer dat God helps us live in unity in this family.)
- Nothing sweet pass one mind for dis life. — (NSC_2021, In this life, unity of purpose is the best.)
- E suppose make sense make people sey dey di same house get di same mind. — (NSC_2022, People who live in the same house should have similar ideas.)
- Sey wetin person tink about someting or person.
- Dem tell BBC Pidgin dia mind. — (bbc__23694, They gave BBC Pidgin their Opinion.)
- We fit talk our mind now before di money come? — (NSC_2021, Can we say our opinion before the money is paid?)
- Dem tell BBC Pidgin dia mind. — (bbc__23694, They gave BBC Pidgin their Opinion.)
- Sey make person get courage and fit do strong ting.
- E kill big snake, e really get mind I beg. — (NSC_2021, He actually is bold to have killed a snake.)
- No be sey di matter hard like that, but na if your mind carry am na im be di ting so. — (NSC_2021, It is not that the matter is tough, but your possession of the issue is that the courage needed is in doubt.)
Related forms
Synonyms
Translations
- English: opinion, courage, mind
Verb
- Make person dey reason someting.
- Me I fit fight anybody wey insult my mama. I no mind who im be. — (NSC_Legbeti_2021, I will fight whoever insults my mother regardless of who the person is.)
- No mind am. — (ENU_16_Fishfarm_DG__173, Don't mind him.)
- My papa no mind am, e continue to dey give magazine to people wey gather. — (jw__27802. My father ignored him and continued sharing the magazine to everyone gathered.)
- abeg leave my daughter make you mind your own business. — (NSC_Legbeti_2021, Please mind your business nd leave my daughter alone.)
Synonyms
Translations
- English: disregard or ignore
Idiom
- De dey use am talk of someting wey dey disturb person for mind wey de make am worry or tink.
- O boy my mind no reach ground at all. Evryting just tire person. — (NSC_2021, Dear friend I am really worried. I am tired of everything.)
- My wife dey hospital as I dey yarn with you so. My mind dey up and I dey find money wey I go give dem for hospital. — (NSC_2021, My wife is at the hospital. I am so worried and I need money to settle the hospital bills.)