okririkpoto

Naija

Alternative Form

okiriboto

Etymology

  • From: unknown

Pronunciation

ɔ̀kɪ̀rìkpɔ̀tɔ̀


Noun

  • Wetin dey spoil person body wey dey person body wey dem fit get if de no use condom take nack. / Crawcraw wey dey catch nyash. If di person wey get di crawcraw dey scratch am, e go dey sweet am. As e dey scratch am, di crawcraw fit dey comot water.
  • If you go park for Benin, you go see people wey dey sell agbo. De go swear sey di drug fit cure headache, stomach pain, jedijedi, all di okirikpoto wey dey e dey cure am.  — (If you go to a park in Benin, you'll find people who sell herbs. They will swear that their drugs can cure headaches, stomach aches, piles, and all sexually transmitted diseases.)
  • No dey carry treat okirikpoto, go hospital fess.  — (Don't just treat Sexually transmitted diseases without information, go to the hospital first.)
  • No carry okirikpoto go meet your wife for house, do normal!  —  Don't take sexually transmitted diseases to your wife at home. Behave yourself.)

Synonym

crawcraw

Translation

  • English: sexually transmitted diseases, skin infection