play
Revision as of 01:00, 7 November 2020 by 129.205.124.158 (talk)
Naija
Etymology
From: English play
Pronunciation
- plȇ
Frequency
- Frequency in NSC treebank: 68
- Frequency rank in NSC treebank: 191
- Frequency in raw corpus: 2339
- Frequency rank in raw corpus: 172
Definition
- As person take dey catch fun.
Noun
- As person take dey catch fun.
- Di play wey di pikin dem dey play too rough. — (NSC_ Odirin_2020, The children's play is too rough.)
- This kind play na serious matter, because e fit lead to rape. — (jw__36959, This manner of behaviour is a serious matter because it can lead to rape.)
- Papa Emeka, you know sey children like play pass food so no dey blame am sey e no quick return from school. — (NSC_Odirin 2020, Papa Emeka, you know that children prefer play to eating so do not scold him for coming back late from school.)
- Drama wey person write.
- Di play don land for pidgin. — (bbc__101844, The play is now in pidgin.)
Related forms
Translations
- English: activity, game
Verb
- Make person dey move bodi take catch fun.
- Na so we play tire when school close today. — (NSC__Odirin 2020, That is how we played to the point of exhaustion after school closed today.)
- De go go play for sun, use sand rub head, rub face, take am bath. — (NST_cleaned_21878, They will go and play in the sun, rub their heads with sand, rub their faces, bathe with it.)
- Sey person no serious for someting.
- Some of dem no dey take this work wey we give dem play. — (jw__980, Some of them are serious with this work we gave them.)
- Make person dey move bodi for game.
- But dem go need play as independent sport people dem. — (bbc__22028, But they will need to play as independent sports persons.)
- Sometime only me go just dey like dis dey play wit my leg. — (KAD_07_Receptionists_DG__171, Sometimes, I alone will just be there playing with my leg.)
- Make person take wayo collect someting.
- You just dey chop mouth sey you too sharp sake of sey correct yahoo boy never play you before. — (NSC_Odirin 2020, You are there boasting that you are not gullible because a seasoned fraudster has not played you before.)
- Make person start film or music.
- Abeg play your marriage video make I see as you take kiss your bride. — (NSC__Odirin 2020, Please play me the recording of your marriage so I will see how you kissed your bride.)
- Di Dj no gree play Davido and Wizkid song for di party. — (NSC_Odirin 2020,The Dj refused to play Davido's and Wizkid's songs at the party.)
- Apart from that one, e arrange Levite wey go dey sing and play music. — (jw__25331, Besides that, he arranged Levites who will sing and play music.)
- Make person perform.
- Super Eagles no fit even draw with Algeria for friendly because di players no play with church mind make injury no bench dem for di season wey just start. — (NSC_Odirin 2020, The Super Eagles could not manage a draw with Algeria in the friendly match because the players did not give their best for fear of getting sidelined due to injury this new season.)
- Make Man U. fans ready sey na Europa League sure for dem if di players no wan play well this season. — (NSC_Odirin 2020, Man U. fans should prepare their minds that the players will definitely end up in the Europa League if they do not perform well this season.)
- You sabi di people wey dey play? — (KAD_03_Why-Men-Watch-Football_MG__15, Do you know those who are playing?)
- Sey someting dey sup.
- You know wetin de play… — (ENU_Football_Fans__Discussion_DG, Do you not know what is happening?)
- Make person dey gamble.
- People dey think sey person wey dey play Bet9ja no dey serious for life. — NSC_Odirin_2020, People think a person who gambles is unserious.)
- Sey person dey do someting for any place or anybody.
- Na Nigeria youth dey play better role for di country pass people wey dey power. — (NSC__Odirin 2020, It is the Nigerian youths who are doing positive things in the country than the ruling class.)
- Di girl don play better role for di guy life. — (NSC__Odirin 2020, The girl has played a huge role in the guy's life.)
- Sey person dey romance person.
- Di way di babe hair scatter when e come out for oga office e clear sey dem don play wella. — (NSC_Odirin 2020, From the way the lady's hair was dishevlled when she came out of the boss' office it is clear that they have been romancing.)
Related forms
Synonyms
- perform, knack,
Antonyms
- work
Translations
- English: to play, to trick, to flirt, to perform,