senior
Naija
Etymology
From: English senior
Pronunciation
- sínjɔ̀
Noun
- Person wey don pass junior level for school.
- Dat senior for grammar school dat year na kura. — (NSC_2020, That senior student in our secondary school was quite notorious.)
- All di senior sabi oppress junior collect deir food money. — (NSC_2020, The senior students are fond of bullying the junior students and dispossessing them of their pocket money.)
- Person wey be sey im get level pass for area.
- Senior, as you don talk am na so e go be. — (Leader, it is going to be just as you have said.)
- Make we go senior house, at all at all, we go see food chop. — (Let us go to the leader’s house, at the worst, we will get some food to eat.)
- Person wey be sey e first peron dey learn work for place.
- Your senior dem never learn dis style finish, go sabi march machine fess. — (The senior colleagues haven’t mastered this style yet, go and learn to use the machine first.)
- Oga and senior don dey waka kurukere waka. — (The boss and the most senior apprentice have been doing shady thing.)
Translation
English: senior, leader, elder, boss, senior apprentice
Adjective
- Na sey person old pass anoder person or get position wey high pass anoder person own.
- Na Ezeudu be senior for this quarter for Umuofia. — (katakata__576, Ezeudu is an older person in Umuofia.)
- Na im be di most senior pesin wey dem vote for inside our party. — (bbc__5106, He is the highest ranking person in our party.)
- Dis na di most senior official for Trump government wey go visit Nigeria. — (bbc__41380, This is the highest ranking official in the Trump administration to visit Nigeria.)
Translation
English: elder, senior
Verb
- Make person age or level pass anoder person own.
- Na everything I use senior you. — (LAG_22_I-Senior-You_DG__85, I am better than you in every ramification.)
- I senior you. — (LAG_22_I-Senior-You_DG__86, I am older than you.)
- Dat guy senior me by far. — (Egbokhare__2020, The guy is much more older than myself.)
- Di woman senior me, but I senior am. — (LAG_11_Adeniyi-Lifestory_MG__125, She is older than me, but I am superior to her.)
- Di woman go fit warn di man one day sey I senior you o! — (BEN_37_French-President-Marriage_DG__64, In the future, she could use the fact that is older than her husband as trump!)
Related forms
Synonyms
Antonyms
Translations
- English: older one, superior