service

Naija

Etymology

From: English service

Pronunciation

  • sɛ́vìs

Play

Noun

  1. Time wey de dey use worship for church.
    • I bin go morning service.  — (I went for church service in the morning.)
    • Im wan go service.  — (ENU_22_Barman-Interview_MG__59, He wants to go to church service.)
  2. Di short form wey de dey take call di National Youth Service Corps (NYSC) wey student wey finish university dey use serve deir papa country, Naija.
    • I con go for service for Bayelsa State.  — (WAZP_07_Imonirhua-Lifestory_MG__26, Then I went into the Youth Service Corps in Bayelsa State.)
    • Okay so my plan be sey, if I finish from here, I finish my NYSC, I for don finish my service, I go do, I wan do my masters.  — (NST_cleaned__2030, I plan to pursue a masters degree after completing national youth service.)
  3. Di kind ting wey private company or government office people dey do for person con collect money for im hand because of am.
    • Make sure say your network get good coverage before you use di service.  — (bbc__64929, Be sure to have stable internet network first so you can enjoy using the service.)
    • Oga in charge for di service say di business get profit yakata if you know di koko.  — (bbc__77035, The boss providing the service affirmed that the business is quite profitable so long as one knows the ropes.)
    • Dis new service go dey on top digital platforms and go use Pidgin wey dem dey speak for West and Central Africa as dem language.  — (bbc__41872, The new service which will be in West and Central African Pidgins will be on the internet and other online platforms.)
  4. Network for internet wey e de dey inside person phone.
    • If you like go buy kpalasa phone o, na so service go hard you find see.  — (If you buy a regular phone you may find it hard to get network access.)

Related forms

Synonyms

Translations

  • English: church service, National Youth Service Corps (NYSC), service, internet network

Verb

  1. Na as de dey change oil wey dey inside motor engine put new one and clean inside motor engine make e dey work fine more more.
    • E good make person dey service motor or generator before e make engine no go knock.  — (A car or generator should be serviced from time to time so the engine does not become faulty.)
  2. Na sey man dey sleep with woman.
    • Husband wey dey service e wife well no dey get di kind problem wey di one wey no dey service e own well go get.  — (The problem that a husband who has regular sex with his wife may encounter in his marriage differs from that of his counterpart who falls short in that regard.)

Synonyms

Translations

  • English: car servicing, to have sex