show
Naija
Etymology
From English: show
Pronunciation
- ʃoʊ̂
Noun
- Place where people dey go to flenjo.
- E, e get one show I no tell you, e get one show for ABJ wey I go for. — (LAG_14_Charles-And-Alfred-On-Music_DG__196, There's a show I didn't tell you about it, it's a show I attended at ABJ.)
- Tiwa perform for di show — (bbc__94150, Tiwa performed at the show.)
- Programme wey de dey show for tv or radio.
- Padi, padi is di name of di show. — (WAZL_09_Talk-Show-Catman_DG__45, Padi padi is the name of the TV show.)
- Former governor of di state Donald Duke na one of di biker's wey been dey on show. — (bbc_ The former governor of the state, Donald Duke was one of the biker's that have been featuring on the programme.)
Synonyms
Translations
- English: party, programme on the media
Verb
Transitive
- Make person express someting.
- Dey show love. — (jw__7000, They showed love.)
- I want show am di seriousness of wetin e talk. — (NSC_Tella_2020, I want to let him realise the gravity of what he said.)
- To thank you for this love you show. — (jw__37824, To appreciate you for the love expressed.)
- Make di truth about someting or person come out.
- But di proof wey dey di mata dey show say na from cells cancer dey from start. — (bbc__22320, But the evidence shows that cancer starts from the cell.)
- Oga Aleburu dey advice say you fit just search di online vendor on top Google and everything about di company go show. — (bbc__89634, Mr Aleburu advised that one can make use of the google search engine to search for vendors online and everything about the company will be seen.)
Intransitive
- Make person see someting.
- E dey use am show sey wetin e talk must happen. — (jw__38259, He used it to show that what he has said will come to past.)
- Wetin happun yesterday show say di movement ready to protest no mata what. — (bbc__4287, What happened yesterday proves that the movement is ready to protest no matter what.)
Serial Verb
- You go show love for di party. — (NSC_Tella_2020, You went to display love at the party.)
Synonyms
- say, arrive, yarn
Antonyms
- waka, comot,
Translations
- English: To see, reveal, express and come around.