touch

Naija

Etymology

From English: touch

Pronunciation

  • tɔ̂tʃ


Verb

  1. Make person carry im hand go meet anoder person body
    • No touch your radio o.  — (WAZA_12_Lady-G_M__33, Don't touch your radio.)
    • If you touch stove wey dey hot wit your hand, e go burn you o!  — (NSC_Legbeti_2021, If you touch a hot stove, you will burn your hand.)
  2. Make person body meet wit anoder person own.
    • Husband and wife fit touch demsef anyhow, e no wrong.  — (NSC_Legbeti_2021, A couples are free to engage in all kinds of romance.)
    • Some women ehen, once dem husband touch dem like dis, na belle straight.  — (NSC_Legbeti_2021, Some women are very fertile, once they make love with their husbands, they get pregnant.)
  3. Make person try beat or try start fight with anoder person.
    • No touch dat pikin if not you go see my red eye!  — (NSC_Legbeti_2021, Don't think of beating that child or you will have me to contend with.)
    • Touch me, and you go know!  — (IBA_41_Christ-Passion-Finale_MG__45, Touch me, and you will know!)
  4. Make person talk someting wey fit dey do person church mind one kind kind.
    • De beggar talk wetin touch me.  — (NSC_Legbeti_2021, The beggar's tale broke my heart.)
    • This one go help us touch their heart.  — (jw__37097, This one will help us melt their hearts.)
  5. Make someting fit scatter someting.
    • No touch our peace, say no to violence.  — (bbc__97092, Do not disturb the peace, avoid violence.)
    • So as to avoid tori wey dey touch.  — (bbc__9317, So as to avoid disruption.)
  6. Make person dey play or carry someting wey e no suppose take.
    • I go tell Oga say you don dey touch company money.  — (NSC_2021, I will inform the boss that you have been tampering with company's money.)
    • To dey do am every three-three month no too much, especially if you get very fine phone wey people just like to dey touch.  — (bbc__80573, Quarterly security check is not too much especially if people tamper with your phone often.)
  7. Make person craze.
    • Him begin craze after wire wey dey him brain begin touch.  — (NSC_2021,He has lost his sanity.
    • Di wire dey touch. Im head dey touch.  — (Egbokhare_2020, He is suffering from mental issues.)

Related forms

Synonyms

Translations

  • English: touch,disrupt, crazy