bail
Naija
Etymology
From: English bail
Pronunciation
- bêl
Noun
- Money wey person dey pay take comot for police cell.
- You no dey when de talk sey bail na free? Why you dey ask my client make e pay money? I go report you just now just now! — (NSC_2020, Weren't you there when they said that bail is free? why are you asking my client to pay. I will report you immediately.)
Translations
- English: bail
Verb
Transitive
- Make person pay money make person comot for police cell.
- Omo, if una no bail una broder, de fit carry am go prison o. — (NSC_2020, Man, if you don't bail your brother, they may carry him to the prison. )
Intransitive
- Make person run like sey e want save imsef.
- As kalampo come, we bail once! — (NSC_2020, As soon as the police arrived, we ran away immediately.)
Related Forms
Synonyms
Antonyms
Translations
- English: take off, run away