fake

Naija

Etymology

From: English fake

Pronunciation

  • fêk

Play


Noun

  • Someting wey resemble original, but no be original.
You sef wey you dey shout sey you dey vex sey you buy fake, you bin feel sey you go see original buy for dat money wey you carry?  — (You are not happy that you bought a fake, were you expecting to buy an original with that amount?)
  • If you dey go market, open eye wellwell o, if you buy fake come give me, you go give me my money o, no tink sey because I dey follow you laugh sey na play I dey play.  — (If you go to the market, please pay attention. If you buy a fake and bring to me, you'll refund my money. Don't think that because I'm laughing, I'm playing with you.)

Synonyms

Antonyms

Translations

  • English: ingenuine thing

Adjective

  • Someting wey resemble original, but no be original.
  • If dem begin count people wey fake drug don kill for dis area, you go weak.  — (If they start to count people who have been killed by fake drugs, you'll be numb.)
  • Which kind money you want save wey go make you go buy fake sheltox? Shey you want dey whine mosquito ni?  — (What sort of savings do you want to do and you decided to buy fake insecticides? Are you playing games with the mosquitoes?)

Translation

  • English: fake

Verb

  • Make person do like sey e be someting or someting dey do am, when e no be di ting or noting dey do am.
  • No be everyting person dey fake. How you go fake sey you sabi swim? Na God save you sey people wey real sabi de dere. You for drink water full belle today.  —  (You can't just fake everything. How will you lie that you know to swim? Thank your stars that people who could actually swim were there. You would have taken more than a mouthful of water today.)
  • Police don gbab dat man wey dey fake sey im be lawyer. Im go police station go bail person, im and di person, na inside cell de dey as I follow you talk so.  — (The police have arrested that man who has been pretending to be a lawyer. He went to the police station to bail someone, but they've locked him up with the person now.)

Translation

  • English: fake, pretend, lie