weewe

Naija

Etymology1

From English: wee

Pronunciation

  • wíwî

Play Play

Noun

  • Wetin man dey take piss.
  • Di pikin dey run naked up and down with im weewe for inside compound.  — (The child runs about naked with his penis exposed.)
  • I hear for news say one woman cut her husband weewe, because say she catch am dey cheat.  — (I heard in the news, that a certain woman cut off her husband penis because he was caught cheating by her.)

Synonyms

Translations

  • English: penis

Verb

  • Make person dey comot wetin be like water from im brokos or toto.
  • He dey weewe for night.  — (He urinates at night.)
  • After e don high, na bush e don dey weewe.  — (After taking a lot of alcohol, he goes to the bush to urinate.)

Synonyms

Translations

  • English: urinate

Etymology2

  • From:English weed (Cannabis sativa)


Pronunciation

  • wíwî

Play Play

Noun

  • Leaf of plant wey people dey use do manymany tings make dem fit high.
  • He dey take weewe for night.  — (He smokes marijuana at night.)
  • Weewe don scatter dat boy head.  — (The use of Indian hemp has messed up the boy’s head.)
  • No be you tell me sey dose men wey dey do konkri dey put weewe for beans chop?  — (Weren’t you the one who told me that those bricklayers but marijuana in the beans they cook?)

Synonym

igbo

Translation

  • English: Marijuana, weed

Etymology3

  • From: English we

Pronunciation

  • wíwî

Play Play

Pronoun

wewe

  • Wetin person dey use talk about imsef and oder people wey dey as e dey talk.
  • Everyting wey I don talk how we go make dis country better, no be person from jand go come do am for us. Na still weewe, na we go do am.  — (Someone abroad won’t be the one to get everything I have said here done. It is up to every one of us.)

Translation

English: everyone of us

Adjective

  • Wetin person dey use talk sey im and di people wey dey as e dey talk, na dem gader dey.
  • Dat level na weewe. You suppose know. No be everybody wey come ask you question you go yarn as tings be.  — (That thing is exclusive to us. You should know. You can't just tell everyone about these things.)

Translation

  • English: exclusive to us