comot
Naija
Etymology
From: English come and out.
Pronunciation
- kɔ̀mɔ̑t
Transitive Verb
Make person or someting remove person or someting.
- If our own die, we go dey comot am dey put am for our room. — (NST_cleaned__22539, If our own die, we will be removing it and put in our rooms )
- If any of dem don dey get this kind mind or dey ‘eye’ person wey no be their husband or wife, make dem quick comot am for mind. — (jw__45136, If anybody has been getting this type of mind or is looking at a person that is not their husband or wife, they should remove it from their mind immediately.)
Intransitive Verb
- Moh waka leave.
- Di guy don comot. — (NSC_Tella_2020, The guy has left.)
- Comot! — (IBA_42_Barrabas_DG__159, Leave !)
- I wan comot. — (ABJ_GWA_10_Steven-Lifestory_MG__184, I want to leave.)
- Make e show face.
- True true, the sun no comot for the whole day until Israel people finish Canaan and their soldier. — (jw__9332, Of a truth, the sun did not set for the whole day until the people of Israel finished Canaan and their host.)
- Why Joshua go tell Jehovah sey make sun no comot when that kind thing never happen before? — (jw__9330, Why will Joshua tell Jehovah that the sun should not set when that kind of thing has never happened before?)
- Make a woman drop engine.
- Some women now, if de get belle, de go say if de take water leaf, di belle go comot because deir belle soft. — (BEN_07_Child-Spacing_DG__115, Some women now, if they are pregnant, they say that if they eat water leaf they will abort because their belly is soft.)
- To con recover (from someting).
- According to Mr Aremu, Nigeria no go fit comot from 'economy recovery' if dem no dey pay workers well. — (bbc__11502, According to Mr Aremu, Nigeria can not recover from the ecomony, if they don't pay their workers well)
Serial Verb
- Di solider beat life comot di guy — NSC_Tella_2020, The solider beat the guy to stupor.)
Related forms
Synonyms
Antonyms
Translations
- English: get out, forget