enter

Naija

Alternative forms

enta

Etymology

From English: enter

Pronunciation

  • ɛ́ntà


Verb

  1. Make person or someting move inside anoder place.
    • You know sey pot sef, di size dey regulate di amount of food wey fit enter.  — (JOS_26_Small-Talk_DG__185, You know that even the pot, the size regulates the amount of food it can contain.)
    • E pain me enter my blood.  — (ENU_20_Relationship-With-Women_DG__136, It pained me deeply.)
    • To enter di stadium sef no go sweet you.  — (KAD_02_Football_M__34, to enter the stadium won't excite you.)
  2. Make person follow join for someting.
    • I con follow dem dey enter church.  — (ENU_15_Music_M__16, I was attending church with them)
    • Go enter Facebook.  — (ENU_07_South-Eastern-Politics_M__121, Log in to Facebook.)
  3. Make person beat person.
    • De enter dat guy wey insult chairmo eh, when de mend am finish eh, im eye be like puffpuff  — (That man who insulted the kingpin was thoroughly beaten, after he was beaten, his eyes were swollen.)
    • Continue dey talk praprapra when de enter you, you go know as e dey be.  — (Keep running your mouth, when they beat you, you'll know.)
  4. Make person use style style become anoder person paddy paddy.
    • Omo, dat guy don enter oga wife well well, anyting wey e talk, she dey quick gree.  — (Man, that man has schemed his way into the good graces of the boss' wife. She consents to whatever he says.)
    • No use because e get small voice dey leave am o, e want enter you like dis.  — (Don't excuse him because he has a tiny voice, he is trying to warm his way into your good graces.)
  5. Make man nack woman.
    • Sey person enter woman no be wetin go make am be man.  — (Because a person sleeps with a lady does not mean that he is man.)
    • If you like go enter who big pass you, di way wey men go take enter you eh, just comot body o.  — (If you decide to have sex with someone not in your class, you could get in serious trouble. Just stay away from all of that.)
  6. Make someting work as de want make e work.
    • Omo dat match, just dey plan for dat ticket mey just enter.  — (KAD_14_Stephen-Silas-Betting_DG__13, Guy, that match, I'm just planning for that ticket, let it just enter.)
    • Dat seminar, e enter die!  — (That seminar went really well.)


Related form

enter eye

Synonyms

mend, wound, nack

Antonyms

comot

Translations

  • English: enter, scheme, have sex with, beat, succeed