follow

Naija

Alternative Form

Etymology

From: English follow

Pronunciation

  • fɔ́lò

Play Play

Verb

  1. Sey person join anoder person go do someting.
    • Follow Richard go buy medicine, e no well.  — (Go with Richard to get drugs, he is ill.)
    • Follow am, look deir face well o.  — (LAG_39_Recording-Wahala_T__128, Accompany him to have a good look at their faces.)
  2. Sey dem born person after anoder person.
    • Who dem born follow you?  — ( Who is your immediate younger sibling?)
    • Na im dey follow me for house.  — (He/she is younger than me.)
  3. Wetin happen after someting don first happen.
    • After she slap am, you still dey ask me wetin follow? Na big fight follow straight?  — (After he slapped her, you are asking what happened next? a big fight followed swiftly.)
    • Some of di reactions wey follow wetin e talk, no make sense.  — (The reactions that followed his comments were negative.)
  4. Sey make person gree do someting wey dem say make e do.
    • To run from wahala, e better to follow wetin dem talk for inside law.  — (To avoid troubles, better to obey the law.)
    • Choose wheder na juju abi God you go follow.  — (Choose whether you will serve the gods or God)
  5. Sey person or someting gree wit someting.
    • Wetin Oti tok follow for wetin dem write for di report.  — (bbc__99058, Oti's statement agrees with the contents in the report.)
  6. Make person be part of someting.
    • Me sef follow support sey make we stop work until dem pay di three months salary wey dem dey owe us.  — (I support the indefinite strike over the 3 months unpaid salary.)
    • Even pikin dem wit autism follow.  — (bbc__47566, Even the children with autism are included.)
  7. Make person mind dey for someting.
    • Shey you dey follow wetin she dey teach  — (Hope you understand what she is teaching.)

Derived forms

followcome, followfollow

Synonyms

Translations

  • English: conform, pursue