Difference between revisions of "follow"
EmekaFelixO (talk | contribs) (→Naija) |
|||
Line 1: | Line 1: | ||
==Naija== | ==Naija== | ||
===Alternative Form=== | ===Alternative Form=== | ||
− | [[follo]] | + | * [[follo]] |
===Etymology=== | ===Etymology=== |
Revision as of 22:51, 20 August 2021
Naija
Alternative Form
Etymology
From: English follow
Pronunciation
- fɔ́lò
Verb
- Sey person join anoder person go do someting.
- Follow Richard go buy medicine, e no well. — (NSC_Legbeti_2021, Go with Richard to get drugs, he is ill.)
- Follow am, look deir face well o. — (LAG_39_Recording-Wahala_T__128, Accompany him to have a good look at their faces.)
- Sey dem born person after anoder person
- Who dem born follow you? — (NSC_Legbeti_2021, Who is your immediate younger sibling?)
- Na im dey follow me for house. — (NSC_Ajede 2020, He/she is younger than me in age.)
- Wetin happen after someting don first happen.
- After she slap am, you still dey ask me wetin follow? Na big fight follow straight? — (NSC_Legbeti_2021. After he slapped her, you are asking what happened next? a big fight followed swiftly.)
- Some of di reactions wey follow wetin e talk, no make sense. — (NSC_Ajede_2020. The reactions that followed his comments were negative.)
- Sey make person obey someting.
- To run from wahala, e better to follow wetin dem talk for inside law. — (NSC_Legbeti_2021. To avoid troubles, better to obey the law.)
- Choose wheder na juju abi God you go follow. — ( NSC_Ajede_2020, Choose whether you will serve the gods or God)
- Sey person or someting gree wit someting.
- Wetin Oti tok follow for wetin dem write for di report. — (bbc__99058, Oti's statement agrees with the contents in the report.)
- Make person be part of someting.
- Me sef follow support sey make we stop work until dem pay di three months salary wey dem dey owe us. — (NSC_Legbeti_2021, I support the indefinite strike over the 3 months unpaid salary.)
- Even pikin dem wit autism follow. — (bbc__47566, Even the children with autism are part of it__)
- If to say Chima follow, e, e for... — (NST_cleaned__38602, __If Chima were a part of it, he would have...__)
- Make person mind dey for someting.
- Shey you dey follow wetin she dey teach — (NSC_Ajede_2020. Hope you understand what she is teaching.)
Derived forms
Synonyms
Translations
- English: conform, pursue