guy

Naija

Etymology

From English: guy

Pronunciation

  • gâɪ

Play Play

Noun

  1. Name wey de dey call man.
    • Who be dat guy wey I see una dey talk?  —  (Who is the man I saw you talking to ?)
    • Wetin do dat guy wey bin dey run viewing centre for dat street?  —  (What happened to that fellow who was managing the viewing centre?)
  2. Person friend.
    • Shola na my guy.  —  (Shola is my friend)
    • Baba, no be your guy dey call you so?  —  (Bro, isn't that your friend calling you?)
  3. Name wey be like title wey de dey use dey call man. Na people wey be like de dey di same age, or de no use anyting pass diersef, na dem dey use am.
    • Guy, shey you go like take one bottle?  —  (Bro, you'll like to take a bottle, right?)
    • Guy reason di levels, e fit pure laslas.  — (Bro, think about the matter, it could come good in time.)
  4. As person dey do wey be sey e dey like make people dey see am sey e fine.
    • You too dey do guy. Tank God sey you short. Like sey you con tall follow am, you for don use talk wound us for dis house.  —  (You like to swagger around. Thank God you are short. If you were tall, you would have talked us to death in this house.)
  5. As person dey do wey be sey e want make de dey beg am make e do someting.
    • Na your turn o. Na im make you dey do guy. Na since morning we don dey beg you. No wahala.  —  (It's up to you. That's why you are making us beg you. We have been begging you since morning. It's all good.)

Related Forms

guyman

Synonyms

man, omo, mehn, baba

Translations

  • English: guy, show-off, difficult

Verb

  • Make dem cheat peson.
  • Omo, you see that watch wey chidi buy? Omo, de guy am.  —  (Bro, you see that wristwatch Chidi bought? Bro, He was cheated.)
  • If you dey go dat plaza, open eye o. De dey guy men for dat side.  — (If you are going to that plaza, be alert. They cheat people there.)

Synonyms

cheat, obtain,

Antonyms

help

Translations

  • English: cheat