leg

Naija

Etymology

From: English leg

Pronunciation

  • lɛ̂g

Play Play

Noun

  1. Part of person body wey begin from waist go down wey person dey take waka.
    • Put your leg for the trouser make you check am if e size.  — (Put your leg in the trouser to check the fitting.)
    • Cross your leg,  — (JOS_07_Trousers-And-Short-Skirts_DG__129, Cross your legs.)
  2. Match wey dem dey play home and away.
    • Di second leg turn to Messi show afta im two quick goals.  — (BBC__38172, _The match favoured Messi in the second leg after his two quick goals.)
    • Dem go play di second leg for di weekend of October 20-22.  — (BBC__29212, They will play the second half by the weekend of October, 20 - 22)
  3. Make something end well.
    • One of di paper I submit give government don get correct leg.  — (One of the bids I submitted to the government has made progress.)
  4. Wetin stool and table dey take stand.
    • If the stool leg don break, carry am go give carpenter.  — (If the stand of the stool is broken, take it to the carpenter.)
  5. Part of trouser wey dem dey put leg.
    • I wan go see my tailor make e patch di left leg of dat my trouser wey tear.  — (I want to see my tailor to amend the left leg of my torn trousers.)
  6. Make person get one kind mind to do someting.
    • I don warn am sey make e no ever try dat kind rubbish for my side. Wetin wan dey bring dat kind leg now. Abi e no dey fear face?  — (I have warned him to never try that sort of nonsense with me again. Why will he dare to do that? Doesn't he have any respect?)

Related forms

1st leg, 2nd leg, return leg, k-leg, bow leg

Synonyms

Antonyms

Translations

  • English: trek, influence, limb, knock knees

Verb

  1. Make person trek.
    • We fit leg am from here to church.  — (Egbokhare_2020, We can actually walk down to church.)
  2. Make person use connection or influence get advantage.
    • We fit leg that matter?.  — (NSC_2020, Can we use influence to solve that matter?)
    • when we reach the policestation, oga leg di level.  — (NSC_2020, When we got to the police station, my boss influenced the issue.)

Related forms

1st leg, 2nd leg, return leg, K-leg, bow leg

Synonyms

Antonyms

  • hand

Translations

  • English: trek, influence, limb, knock knees