press

Revision as of 20:00, 24 November 2022 by Shula (talk | contribs) (→‎Verb)

Naija

Etymology

From: English press

Pronunciation

  • prɛ̂s

Play Play

Verb

  1. Make person use iron wey dey hot take straight cloth.
    • Joke, abeg help me press my shirt now.  — (Egbokhare_2021, Joke, please kindly iron my shirt for me now.)
  2. Make person put power for hand or leg take do someting.
    • If you dey drive no too dey fire am. Dey press am small small.  — (NSC_2022, If you are driving, don’t accelerate too much. Step on it gently.)
    • Press di egusi so dat oil go comot!  — (KAD_10_Egusi-Soup_MG__22, Squeeze the egusi to extract oil from it.)
    • You dey find mama? she dey where de dey press oil comot from banga for dere.  — (NSC_2021, Are you searching for the old lady? She is at the mill.)
    • Some kind better moto, you no need too press di brake. E dey sharp, e dey hold; but you see all dose jalopy, you go don first chop better six to six before you go fit press di brake.  — (NSC_2021, For some good cars, you need to hit the brakes too hard. It's usually good and it works well; But some of these old cars, you'll need to eat fufu before you can hit the brakes well.)
  3. Make person dey do wayo dey collect people money for online.
    • Dis bros don dey press since primary school na when wey e reach university na e come pay.  — (NSC_2021, The now mature guy has persisted in the shady business of cyber theft since primary school; it paid off for him when he was at the university.)
    • You go school finish sey na press you want dey press. Tufiakwa!  — (NSC_2022, After all your education you decided to get involved in internet fraud. God forbid.)
    • E don dey hard to tell area people sey if you press, e go over you last last  — (NSC_2021, It is becoming very difficult to tell the people around that if you get involved in internet fraud, it will end very badly for them.)

Synonym

yahoo

Related forms

Translations

  • English: to iron, squeeze, tap, defraud, hit squeeze