wash
Naija
Etymology
From: English wash
Pronunciation
- wɔ̂ʃ
Verb
Intransitive
- Make someting wey bin dey shine no dey shine again.
- Dis chain don wash now. — (NSC_2021, This chain has faded.)
- You go try paint your car, you hear? Dis paint don wash. — (NSC_2021, You should try to paint your car, okay? This paint has faded.)
- Make person no dey as e dey before.
- Dat guy wey dey do wrestling don wash, de dey beat am anyhow. E no even fit climb rope jump. — (NSC_2021, That wrestler is not as strong as he used to be. He gets beaten a lot now. He can't even climb the top ropes.)
- You want play ball? You no go even run from dis post to di oder post. You don wash, baba rest. — (NSC_2021, You want to play football? You can't even run from this post to that post. You've lost it, get some rest.)
Translation
- English: Fade, flatter
Transitive
- Make dem use water and soap clean someting.
- Patapata di whole of dat day, na so, we wash plate. — (KAD_13_Entering-University_MG__95, So that's how we washed plates for the entire day.)
- Make person dey influence anoder person.
- E go begin wash deir mind. — (deuber__2456, He will soon start to brainwash their minds.)
- Dat woman don wash her husband mind sotey, he no dey tink well again. — (NSC_Olukayode.S.M_2020, The woman has brainwashed her husband, he no longer thinks for himself.)
- Make dem insult person.
- Na so dem wash dat guy finish today for office, as e no get manners . — (NSC_Olukayode.S.M 2020, That is how they insulted that guy thoroughly at the office today, because he is ill-mannered.)
- make person just dey tell person someting wey no be true make di person for happy.
- No use dem play o. If de wash you, you go comot money. — (NSC_2021, Don't joke around with those people. If they flatter you you'll part with some cash.)
Related Forms
Synonyms
Antonyms
Translations
- English: wash, brainwash