pam

Naija

Etymology1

  • From: English palm

Alternative Form

Pronunciation

pâm

Play Play

Noun

  • Wetin person dey do anoder person wey be sey e go open im hand take woze person.
  • Di pam wey e pam you no reach you? You want still go follow am talk?  — ( The slap he gave you was not enough for you? You still want to go to talk to him?)
  • You really want follow welder fight. Deir hand wey turn sandpaper. Di kind pam wey e go give you, your leg go shake enter ground.  — (You actually want to fight with a welder. Their hands are as coarse as sandpaper. If he slaps you, your legs will sink into the ground.)
Synonyms

kpokpo

Translation
  • English: slap, palm strike

Verb

  • Make person open im hand take woze person.
  • E don already comot di phone for pocket. Omo! Naim I turn pam am for back. Di ting shock am, so before e get imsef people don hold am.  — (He/she had already remove the phone from my pocket. Boy! Then I turned and hit him on his back. It stunned him and before he could get to his senses people had held him.)
  • Dis your face swell o. You say e pam you. Baba dis no guy no just pam you. E beat craze comot for your body.  — (Your face is swollen. You said he hit you with his palm? Bro, this guy didn't just hit you with his palm, he beat the living daylight out of you.)
  • Di first ting wey ekelebe dey like di na to first pam person for face first. Dat one go make you forget wey you dey.  — (The first thing the police do when they arrest you is to hit you with their palm on your face. That will make you will lose your bearing.)
Synonym

nack, kpokpo, rush

Translation
  • English: strike with palm, slap

Etymology2

  • From: unknown

Alternative Form

Pronunciation

pâm

Play Play

Verb

  • Make person stay one side.
  • I know wetin de dey do. I just pem dey look dem. De go dey tink sey I no know wetin dey sup.  — (I know what they are doing. I'm just in a corner observing them. I know what they is happening.)
  • Dat deve na im be di matter wey dey ground abi? Just pem, I go handle am.  — (The illegal levy is the issue, right? Just relax. I'll handle it.)
Synonym

kpro, dey

Translation
  • English: stay, hide, relax

Etymology3

  • From: English palm sandals

Pronunciation2

pâm

Play Play

Noun

  • Wetin be like slippers wey man dey wear.
  • I no know who talk sey una must wear pam if una de wear native.  — (I wonder who made the rules that you must wear fancy flip flops if you wear a native attire.)
  • You no use eye see pam. You no go even ask who get am, you go just put leg.  — (You really like fancy flip flops. You don't even ask whose it is. You just wear it.)
Related Form
Translation
  • English: fancy flip flops