Difference between revisions of "pam"
Line 45: | Line 45: | ||
=====Synonym===== | =====Synonym===== | ||
[[kpro]], [[dey]] | [[kpro]], [[dey]] | ||
− | =====Translation==== | + | =====Translation===== |
* English: ''stay, hide, relax'' | * English: ''stay, hide, relax'' | ||
− | |||
===Etymology3=== | ===Etymology3=== |
Revision as of 01:07, 20 December 2021
Naija
Etymology1
- From: English palm
Alternative Form
Pronunciation
Noun
- Wetin person dey do anoder person wey be sey e go open im hand take woze person.
- Di pam wey e pam you no reach you? You want still go follow am talk? — (NSC_2021, The slap he gave you was not enough for you? You still want to go to talk to him?)
- You really want follow welder fight. Deir hand wey turn sandpaper. Di kind pam wey e go give you, your leg go shake enter ground. — (NSC_2021, You actually want to fight with a welder. Their hands are as coarse as sandpaper. If he slaps you, your legs will sink into the ground.)
Synonyms
Translation
- English: slap, palm strike
Verb
- Make person open im hand take woze person.
- E don already comot di phone for pocket. Omo! Naim I turn pam am for back. Di ting shock am, so before e get imsef people don hold am. — (NSC_2021, .)
- Dis your face swell o. You say e pam you. Baba dis no guy no just pam you. E beat craze comot for your body. — (NSC_2021, Your face is swollen. You said he hit you with his palm? Bro, this guy didn't just hit you with his palm, he beat the living daylight out of you.)
- Di first ting wey ekelebe dey like di na to first pam person for face first. Dat one go make you forget wey you dey. — (NSC_2021, The first thing the police do when they arrest you is to hit you with their palm on your face. That will make you will lose your bearing.)
- insert example — ( insert translation )
Synonym
Translation
- English: strike with palm, slap
Etymology2
- From: unknown
Alternative Form
Pronunciation
Verb
- Make person stay one side.
- I know wetin de dey do. I just pem dey look dem. De go dey tink sey I no know wetin dey sup. — (NSC_2021, I know what they are doing. I'm just in a corner observing them. I know what they is happening.)
- Dat deve na im be di matter wey dey ground abi? Just pem, I go handle am. — (NSC_2021, The illegal levy is the issue, right? Just relax. I'll handle it.)
Synonym
Translation
- English: stay, hide, relax
Etymology3
- From: unknown
Pronunciation2
Noun
- Wetin be slippers wey man dey wear.
- I no know who talk sey una must wear pam if una de wear native. — (NSC_2021, I wonder who made the rules that you must wear fancy flip flops if you wear a native attire.)
- You no use eye see pam. You no go even ask who get am, you go just put leg. — (NSC_2021, You really like fancy flip flops. You don't even ask whose it is. You just wear it.)
Related Form
=Translation
- English: fancy flip flops
- English: stay, hide, relax