Difference between revisions of "chop"

Line 5: Line 5:
 
===Etymology===
 
===Etymology===
  
===Pronunciation===ʧɔp
+
===Pronunciation===
 
* ʧɔ̀p
 
* ʧɔ̀p
 
<sm2>Pcm-ng-chop.f.ogg</sm2>  
 
<sm2>Pcm-ng-chop.f.ogg</sm2>  

Revision as of 15:55, 9 October 2020

Naija

Alternative forms

Etymology

Pronunciation

  • ʧɔ̀p

Play Play

Frequency

  • Frequency in NSC treebank: 126
  • Frequency rank in NSC treebank: 116
  • Frequency in raw corpus: 1731
  • Frequency rank in raw corpus: 220

Definition

Sey person put someting for mouth con swallow am.

NOUN

  1. Food wey person fit eat
    • Bush meat na correct chop for Nigeria  — (bbc__9800, Bush meat is a really nice meal )
    • Datti say NEMA plus oda stakeholders wey include local and international NGOs don organise emergency centres, give chop and melecine to displaced pipo.  — (bbc__27134, NEMA and other stakeholders including local and international NGOs have organized emergency centers, giving food, and medicine to displaced people)

Derived forms

chopchop

  1. Person wey be sey e dey chop anyhow.
    • You don chop rice, chop beans, you want still chop moimoi, chop-chop!  —  (NSC_Emeka_2020, You have eaten rice, eaten beans, you still want to eat moimoi, glutton! )
  2. Food wey light.
    • Who buy all dis chop-chop keep for here?  — (NSC_Emeka_2020, Who bought all these munchies and kept them here?)
    • I never chop better ting since morning o, na just dis chop-chop I use take hold body  —  (NSC_Emeka_2020, I haven't eaten any real food since morning, it's just these munchies I've had to hold myself together. )

Synonyms

Translations

  • English: food

VERB

  1. Make person eat food.
    • You wan chop?  — (ENU_13_School-Life_DG__34, You want to eat?)
    • Dat time, I go go chop suya five thousand dey drink anyhow I like.  — (ENU_33_A-Beg_MG__79, At the time, I'll go to eat suya worth five thousand, and drink however I want.)
  2. Make dem use someting spoil.
    • See wetin dat guy don do my slippers, slippers wey I never use, e don use am, e don chop.  — (NSC_Emeka_2020, See what that guy has done to me flip-flops, flip-flops that I hadn't used, he has used it and has worn it out.)
    If you blow am too much, e go dey chop for di centre, but if you...  — (LAG_31_Road-Safety_MG__64, If you blow too much air into it, it will come apart in the middle, but if you...)
  3. Make person collect punishment.
    • Amosun, wey be governor of Ogun State and Okorocha, di Imo State governor chop di suspension on Friday afternoon for Abuja wia dia party claim say di two members involve for anti-party activities.  — (bbc__14929, Amosun, the governor of Ogun state and Okorocha, the Imo state governor received the suspension on Friday afternoon where their party claimed that the two members were involved in anti-party activities. )
    • Siasia also chop fine ontop di mata, Fifa fine am CHF 50,000 wey be $51,025.00. Fifa don tell Siasia about dia decision, di ban go start with immediate effect.  — (bbc__89497, Siasa has also received a fine beacause of the issue, Fifa fined him CHF 50,000 which is $51,025.00. Fifa has told Siasia about their decision, the ban will start immediately. )
  4. Make person win money or someting.
    • I hear sey person chop one million for dat promo wey dat bank do.  — (NSC_Emeka_2020, I heard that someone won a million naira in the bank promo.)
  5. Make dem deceive person.
    If I see dat guy, I go chop am  — (KAD_14_Stephen-Silas-Betting_DG__61, Guy, that guy, if I see that guy, I'll play a fast one on him.)
    If you no monitor am well hm, my sister, make I no deceive you, people go chop you.  — (NST_cleaned__8459, If you don't monitor it well, hm, sis, I don't want to deceive you, he'll take advantage of you.)
  6. Sey person receive someting or person experience someting.
    • Dem don also chop yab on top di video from di ChristChurch killings wia 50 Muslims die as dem bin dey pray.  — (bbc__28886, They have also received criticism on the video from the ChristChurch killings where 50 Muslims died as they were praying.)
    • I bin hear dem dey talk sey dat guy wey dey dribble people till dem turn mumu go chop slap if e try am today.  — (NSC_Emeka_2020, I overheard them say that the guy who dribbles people simply to make them look foolish will be slapped if he tries it today.)
  7. Make person tief money from government or where e dey work.
    • Di former Attorney-General suppose face all di government and public officials, wey dey power before or dey inside office now, wey fit don chop di country money.  — (bbc__94982, The former Attorney-General is supposed to probe all the government officials who were or are still in power, who may have embezzled the country's wealth.)
  8. Sey na di money wey dem spend ontop matter.
    • Dis election chop more than $3billion wey dem use for just media.  — (bbc__40547, This election gulped more than $3 billion which was spent on media alone. )
  9. Make person knack.
    • Ogbeni, hold yourself, no be every person you see you go chop.  — (NST_cleaned__27191, Boy, control yourself, it is not every woman you see you'll just have sex with.)
    • Madam chop di houseboy pursue am con follow driver.  — (NSC_Emeka_2020, The Madam slept with the male domestic servant, sent him away, and went for the driver.)
  10. Make person hustle dey help am dey maintain.
    Na for dat oil company dat guy dey chop.  — (NSC_Emeka_2020, It's at that oil company that he makes his living.)
  11. Make person dey enjoy life.
    I don chop money for dis Nigeria, chop money for South Africa, chop money for everywhere.  — (NST_cleaned__20267, I have earned money in Nigeria, earned money in South Africa, earned money everywhere.)
  12. Sey bad ting happen and people die put.
    Militants attack for Nigeria don reach 9 years since e start for northern part of di konrti and e chop pass 20, 000 pipo head.  — (bbc__67203, Militants attack in Nigeria has lasted for nine years since the start in the northern part of the country and it has consumed 20,000 lives.)


Related Forms

chop mouth

  1. Make person word no clear.
    Wetin you dey talk? If you want cry, cry. No come here con dey talk dey cry, dey chop mouth like pikin  —  (NSC_Emeka_2020, What are you saying? If you want to speak, speak, if you want to cry, cry. Don't come here, crying and biting your lips.)
  2. Make person dey do like sey im know di lyrics.
    Una choir members na minus 1, de just dey chop mouth.  —  (NSC_Emeka_2020, Your choristers can't really sing, they barely know the lyrics.)
  3. Make person dey talk nonsense.
    We dey talk about football team you dey chop mouth dey mention Chelsea. Dat one na team?  — (NSC_Emeka_2020, Why are you mentioning Chelsea when we are talking about football? Is that even a football team?).
  4. Make person kiss person.
    I catch bros and dat babe dey chop mouth o.  —  (NSC_Emeka_2020, I caught brother and that lady kissing. )
  5. Make person talk wetin no be true.
    Politicians sabi chop mouth for Nigeria.  —  (NSC_Emeka_2020, Politicians lie a lot in Nigeria.)

chopulate, chop and quench, chop no pay

Synonyms

Translations

English eat, kiss, mumble