Difference between revisions of "chop"
EmekaFelixO (talk | contribs) |
EmekaFelixO (talk | contribs) |
||
Line 57: | Line 57: | ||
#: {{ux|dv|If you blow am too much, e go dey '''chop''' for di centre, but if you... |(LAG_31_Road-Safety_MG__64, If you blow too much air into it, it will come apart in the middle, but if you...)}} | #: {{ux|dv|If you blow am too much, e go dey '''chop''' for di centre, but if you... |(LAG_31_Road-Safety_MG__64, If you blow too much air into it, it will come apart in the middle, but if you...)}} | ||
====Related Forms==== | ====Related Forms==== | ||
− | [[chop mouth]], [[chopulate]], [[chop and quench]], [[chop no pay]] | + | [[chop mouth]], [[chopulate]], [[chop and quench]], [[chop no pay]], [[I go chop]] |
====Synonyms==== | ====Synonyms==== |
Revision as of 14:40, 10 September 2021
Naija
Etymology
From unknown
Pronunciation
- ʧɔ̑p
Noun
- Food wey person fit eat
- Bush meat na correct chop for Nigeria — (bbc__9800, Bush meat is a really nice meal. )
- Datti say NEMA plus oda stakeholders don organise emergency centres, give chop and melecine to displaced pipo. — (bbc__27134, NEMA and other stakeholders have organized emergency centers, giving food, and medicine to displaced people.)
Derived forms
Synonyms
Translations
- English: food
Verb
Transitive
- Make person put someting for mouth con swallow am.
- You wan chop? — (ENU_13_School-Life_DG__34, You want to eat?)
- Dat time, I go go chop suya five thousand dey drink anyhow I like. — (ENU_33_A-Beg_MG__79, At the time, I'll go to eat suya worth five thousand, and drink however I want.)
- I dey H bad bad, I fit even chop elephant sef. — (NSC_Onwuegbuzia_2020, I am really hungry, I can eat an elephant.)
- Make person collect punishment.
- Amosun and Okorocha chop di suspension on Friday afternoon for Abuja. — (bbc__14929, Amosun and Okorocha received the suspension on Friday afternoon in Abuja. )
- Siasia also chop fine ontop di mata, Fifa fine am CHF 50,000 wey be $51,025.00. — (bbc__89497, Siasa also received a fine because of the issue, Fifa fined him CHF 50,000 which is $51,025.00.)
- Make person win money or someting.
- I hear sey person chop one million for dat promo wey dat bank do. — (NSC_Emeka_2020, I heard that someone won a million naira in the bank promo.)
- Make dem deceive person.
- If I see dat guy, I go chop am — (KAD_14_Stephen-Silas-Betting_DG__61, Guy, that guy, if I see that guy, I'll play a fast one on him.)
- If you no monitor am well hm, my sister, make I no deceive you, people go chop you. — (NST_cleaned__8459, If you don't monitor it well, hm, sis, I don't want to deceive you, he'll take advantage of you.)
- Sey person receive someting or person experience someting.
- Dem don also chop yab on top di video from di ChristChurch killings wia 50 Muslims die as dem bin dey pray. — (bbc__28886, They have also received criticism on the video from the ChristChurch killings where 50 Muslims died as they were praying.)
- I bin hear dem dey talk sey dat guy wey dey dribble people till dem turn mumu go chop slap if e try am today. — (NSC_Emeka_2020, I overheard them say that the guy who dribbles people simply to make them look foolish will be slapped if he tries it today.)
- Make person tief money from government or where e dey work.
- Di former Attorney-General suppose face all di government and public officials, wey dey power before or dey inside office now, wey fit don chop di country money. — (bbc__94982, The former Attorney-General is supposed to probe all the government officials who were or are still in power, who may have embezzled the country's wealth.)
- Sey na di money wey dem spend ontop matter.
- Dis election chop more than $3billion wey dem use for just media. — (bbc__40547, This election gulped more than $3 billion which was spent on media alone. )
- Make person knack.
- Ogbeni, hold yourself, no be every person you see you go chop. — (NST_cleaned__27191, Boy, control yourself, it is not every woman you see you'll just have sex with.)
- Madam chop di houseboy pursue am con follow driver. — (NSC_Emeka_2020, The Madam slept with the male domestic servant, sent him away, and went for the driver.)
- Make person hustle dey help am dey maintain.
- Na for dat oil company dat guy dey chop. — (NSC_Emeka_2020, It's at that oil company that he makes his living.)
- Make person dey enjoy life.
- I don chop money for dis Nigeria, chop money for South Africa, chop money for everywhere. — (NST_cleaned__20267, I have earned money in Nigeria, earned money in South Africa, earned money everywhere.)
- Sey bad ting happen and people die put.
- Militants attack for Nigeria don reach 9 years since e start for northern part of di konrti and e chop pass 20, 000 pipo head. — (bbc__67203, Militants attack in Nigeria has lasted for nine years since the start in the northern part of the country and it has consumed 20,000 lives.)
Intransitive
- Make dem use someting spoil.
- See wetin dat guy don do my slippers, slippers wey I never use, e don use am, e don chop. — (NSC_Emeka_2020, See what that guy has done to me flip-flops, flip-flops that I hadn't used, he has used it and has worn it out.)
- If you blow am too much, e go dey chop for di centre, but if you... — (LAG_31_Road-Safety_MG__64, If you blow too much air into it, it will come apart in the middle, but if you...)
Related Forms
chop mouth, chopulate, chop and quench, chop no pay, I go chop
Synonyms
Translations
English eat, kiss, mumble